Na rich people dey on generator anyhow for dis country now ooo, if no be say anything urgent dey wey I wan use light do, and Nepa light no dey I no dey go near generator.
If you get car for dis country now and you wan reduce d amount wey u dey spend on fuel, d best thing na to just follow commercial transport and you go reduce money wey u go spend on fuel, but the funniest part be say even commercial transporter’s self don add money anyhow now, but e go still better pass if you carry your own car commot.
If you get house now and you wan dey get light always, the best thing wey you go do na just to lock up do solar for your house, I know say solar dey expensive but if you don run am once e don turn your own already, na minor maintenance go remain wey u go dey do. Some people dey wey dey use gas for their generator and dey talk say e dey very economical, but I never try am before and I no sabi how risky it is and how e dey economical reach.