Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: The country no de move forward
by
Adams0001
on 27/07/2023, 19:31:05 UTC
People no go gree understand because nobody dey see the benefit of the remover. Abi we never hear say Dem still dey steal crude? Government no dey sincere especially the last administration and this present one that is still contested in court. How can dey hastily remove subsidy without arranging how the man on the street go survive. Na palliative money Dem still dey want go borrow. The thing no good to hear for ear. Na same people fight president Goodluck Jonathan for the same policy even as him provide palliative wey everybody see.

Na true you talk some people no dey understand something that is why dey use to complain, because of this subsidy were dey remove many people dey suffer, i no say him affect many people in our Naija, because everything just increase price for our country nothing dey cheap again since dey remove fuel subsidy, but i know say Tinibu come to help us for this country we go just dey patient, even dey know remove this subsidy i no dey sure if our country go improve because this our leaders na them dey chop the money nothing he dey benefits us,  if everything balance for our government now fuel go reduce price Weller.