Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 9 from 5 users
Topic OP
GOOD NEWS: CBN DIRECT BANKS TO LIFT RESTRICTIONS ON CRYPTO RELATED ACCOUNTS
by
Odohu
on 28/07/2023, 17:58:29 UTC
⭐ Merited by Ratimov (3) ,EFS (2) ,SmartGold01 (2) ,CryptopreneurBrainboss (1) ,Igebotz (1)
My people, una don hear say CBN don direct all banks to lift all the restrictions wey them sama give some accounts wey dey do business in cryptocurrency and other finTech. To me. This na better news for us wey dey for the crypto industry.

Make una no forget say, the action of CBN be slow down cryptocurrency businesses and activities for our country as many people who for dey use crypto come dey comot body to avoid wahala from our government. Even GTB been carry the matter for head come dey close account of people wey them notice say na crypto or forex them dey do.   But as e be say them don give greenlight say people dey free to use crypto, we go dey expect say crypto will have greater penetration for our country and that na good thing.

This na the article for people wey wan read the full gist:
https://www.primebusiness.africa/cbn-orders-nigerian-banks-to-lift-restriction-on-accounts-of-crypto-other-firms/

My people how una see the matter?