Both long holders and short holders are profitable in their investment but long term holders are more profitable than short term holding, which I have witnessed from some potential investors in d community.
You no want do comparison here I believe but as you con put "but" mean say you dey favour long term investment to be more profitable. Me I no go too agree with you on that. The only thing wey people dey see about long-term be say maybe Dem go dey market when the bull and ATH go happen and e go be like say na Dem make money pass but we never ask ourselves about the accumulation of the short short profit wey dey comot from short term. The ROI for a short term investor fit even make sense pass persin wey leave him investment for 3years. Like we know say within 3years now, btc no go just waka reach that higher highs, the thing go dey drop sometimes too and na so short term investor wey get eyes for back go dey cash out and DCA again to catch up with the next bull etc. So e just depends on the one wey persin like to follow. If I tell you one thing self, na fear dey make some investors leave coins reach 3 years self

Long holding require patience and faith before you can succeed from your investment which those investors planing to upgrade from short holding to long holding to ensure they apply patience and faith whenever there is a bear season.
Not really. Both long and short require patient to cash out. The only thing be say longtime investor go carry more patients and hope for recovery when price fall reach ground like as e happen for 2018 wey price go back to $3,500 after reaching $20,000 plus
Short holders too make a profits from their investment but is not big like d one long term holders are making, because it doesn't need long holding before you can earn from your investment at the moment.
Na the cumulative matter my brother. People no need to switch if them already understand how e dey work for them.