If I may ask about long term holders and short term holders, who profit most? I believe there are some people here who have never experience long term holding but dey want to swatch, what will be your advice to them? Your opinion is welcome.
This one go different and na based on the different coins dem wey you dey interested in wey go determine if you go go long term or short term. If we dey based dis discussion for just bitcoin then na long term wey sure pass because even all the OG wey hold their bitcoin from the day wey Bitcoin was sent to their wallets to dis day go comfirm to you say nothing sure pass for Bitcoin side then to become a long term hodler. Long term holding helps you in so many ways that isn't just profit gaining. If you be long term hodler e go make you develop the habit of patience and this one no go only help you for Bitcoin but all round investment that includes the industry and other investment options.
E go make you to get patience and with patience your investment go dey profit you, if you know wetin you dey invest inside and e no be scam. Short term holding no bad but if you're get the opportunity to choose which one you go belong among the two choices, choose long term hodling. This one go make you get less stressed for the market and all the shakara wey e dey do. But if this topic involved all coin that one be say you need to decide weda you go hold long or short on your own as nobody know how profitable any coin fit dey at a particular time. Altcoins investment dey very unpredictable and e dey get plenty wahala wey be say if you no put your head for ground you fit fall mumu to scammers.