Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 2 from 2 users
Re: Short holder and long holder who profit most?
by
Coyster
on 01/08/2023, 21:07:06 UTC
⭐ Merited by CryptopreneurBrainboss (1) ,Charles-Tim (1)
E get people wey dey hodl some altcoins since 2017-2018, but as e be so, now the coins dey useless and the person no even fit sell am because you no go fit trade am for any exchange, them dey call people wey dey hodl this kind coin bagholders. Thus you don see am say no be by how long you take dey hodl the coin, but na which coin you dey hodl.

If you dey hodl Bitcoin, then na long term make sense pass because Bitcoin get better utility, so long term go bring better ROI, but if it is altcoins wey you dey hodl, you no suppose too hodl am for long oh, dem no dey too get utility, so if you dey hodl altcoin and you don get ROI, just rush go sell am before e dump.