Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Who be the first Nigerian that joined Bitcoin Talk
by
CryptoHeadlineNews
on 02/08/2023, 19:55:59 UTC
Those of una wey enta here afta we get hangout thread, una dey lucky honestly. I know d joy wey e give me d first time I discovered one Naija dude through im username. I think Olubams be d user. Na so I rush d dude inbox. We chatted very well, even off forum for sometime. Na dat merit thing wey forum introduced make d dude slack. He come stop posting as soon as im marry. I tried to encourage him to come back but e nor work.

Shoutout to a man like Brainboss!

Omo.. If there is one thread I don read for this entire month wey give me joy, I go say na this very thread wey just give us all flashback how the history of Naija local board all started. Because truly, reading all the post on this thread just dey give me inner joy & I no go lie, as eh just dey sweet me for body to know how our early founders did struggle just to have us recognized for here and till today, they never tire but still pushing up to carry everybody alone for here.  Omo, na una be the real heroes for here, and I salama my respect to una always @ Sir Brainboss and co.. Una too much