i also found this leo, who i will say he is the oldest member from Nigeria since he registered in 2012
Menh! I doubted dat Leo until I checked and saw he even get post for local sef. I nor go surprise sey e get persin wey enta before him sef dat year wey forum open and still dey post here codedly.
I give it to Brainboss. D guy try to arrange dat owa hangout thread, I nor go lie una. I know how reluctant I was wen im approached me on dat issue. Maybe im go don forget how dat matta take be dat time now. I wanted to just do my stuff without any ish then. Even owa late brother Becky666 follow ginger for the thread then. May God rest his soul.
We nor go too blame those wey no identify with us because e get as here be dat time wen I enta. Una sabi dat kain prejudice thing once outsiders identify you as Naija persin na. Nor be everybodi go fit risk to face mob action like dat wen you dey minority. All man wan protect wetin dey put food for dem mouth, I understand dat part.
I still dey see members wey I know sey dem be Nigerians but dem neva show face for local board unto sey dem wan keep actin foreigner. Some na their usernames dey give dem out while some na their writing pattern. Una sabi sey e get as a typical Naija persin dey take coin words of write English ba, are you understanding me 😆
Those of una wey enta here afta we get hangout thread, una dey lucky honestly. I know d joy wey e give me d first time I discovered one Naija dude through im username. I think Olubams be d user. Na so I rush d dude inbox. We chatted very well, even off forum for sometime. Na dat merit thing wey forum introduced make d dude slack. He come stop posting as soon as im marry. I tried to encourage him to come back but e nor work.
Shoutout to a man like Brainboss!
Special appreciation to our own Naija bBitcoin Chief for this BitcoinTalk Forum wey we all know by the name Brainboss. I don hear many many good things and sacrifices wey this our bossman don do to make things to dey easy for us wey go join the forum later.
Brainboss sir, Na only God go bless you and your likes in this forum for all the good things wey una put in place to make things dey easier for us in this forum. Even as anonymous as the forum take be, we shall one day have a platform to celebrate you and your likes for we Naija. Thank you sir and Sirs