As we Nigerians sabi, this yahoo yahoo wey our youth don turn to daily work don dey too much. Many of us get brothers or even sisters wey dey into this matter, and I no think say dem go stop anytime soon. Dis yahoo yahoo matter don kill many of our youths, some sef don dey kolo for street sake of say dem dey enjoy people sweat. If I remember well, dis yahoo matter don dey around for a while, but na recently na e cast Wella as boys begin carry am dey everywhere.
E get plenty reasons why dem enter this thing including
1. Impatience
2.greed
3. Intimidation
4.depression with many others and I no go blame dem well well because our government no dey organized at all. I go still blame some parents wey no fit guide their pikin well and con leave dem to do bad things, some even dey force them into the matter because of their personal gain.
Plenty of these boys don kill almost all their friends, parents, siblings, girlfriends, all because of money, cars, and other earthly things wey no dey last. Dem dey forget say any tin wey devil give you no dey last, and e go still collect your life join. Me I still dey reason say, if them manage last reach old age, how dem wan take ensure say this work go help dem take care of their family? Na just yesterday, one house for my area wey don tay, na so I hear say the yahoo guy don sell the house because money no dey to finish am. no be every day you go see person thief, but these boys no dey hear and try save dem money for better thing other than woman and club. I even hear one guy talk the other day
e no get as e wan be, fo this yahoo matter we die here
My only question now be say, as dem dey do all these things dey show the younger generations, which example dem dey set for dem? Because as e be now, yahoo don turn work for our country, and e no get how e go be, the new generation go still put hand for this matter. My people, abeg watin una see for this matter?
(OP) yes the matter don pass hand but let look for the other sid of things dis Yahoo Yahoo don really help boys
I no be Yahoo boy but and I no get brother or sister wey dey into am but let keep all the reasons for one side
make we tell which other the full truth e really solve half problem for 9ja.
Mak we talk about this guy matter self RAY HUSH PUPPI the richest Yahoo boy in Nigeria
I think u guys shouldn't be to fast in juagement I think u should read about him how life show am pepper.