Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: [your Opinion] For this country Patient dog still dey eat the fattest Bone???
by
Asiska02
on 06/08/2023, 20:22:07 UTC
What do you guys think about this proverb do you think people still have this patient or they shortcut to get what they want.

Omo, dis proverb na olden days proverb o and if you wan follow am for dis current situation wey we dey for Naija, you go just kpai with hunger, thinking and frustration. Just imagine yourself for how far you don come to dis position wey you dey now, you go tell me say some situation no warrant make you dey patient? But as you see say e no fit work, you still stay back dey wait? I sure say you no wait. They get some kind level wey if you reach dat proverb go fit dey applicable to use but in most cases today, you can’t be patient enough forever when you’re almost dying. D only tin be say make person no go dey think say him dey patient meanwhile na him time e just dey waste dey go like dat.