Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 13 from 8 users
Topic OP
Burue De Change Asking Government to Ban Binance to Save Naira
by
Odohu
on 09/08/2023, 07:25:10 UTC
⭐ Merited by Ratimov (3) ,CryptopreneurBrainboss (2) ,BIT-BENDER (2) ,SmartGold01 (2) ,Charles-Tim (1) ,Igebotz (1) ,gabbie2010 (1) ,DdmrDdmr (1)
My people, e don happen o!  Bureau De Change (the people wey dey incharge of forex aka foreign exchange) don dey tell federal government to ban Binance to save our Naira. This one shock me no be small. I don't know how Binance take dey make our Naira weak abi na Binance dey manage our economy. This one show say the people wey dey handle some of these agencies no even know the things wey fit affect our currency. I truly dey feel bad for this kind news.

We all know say our government no gree create job for the youth, now cryptocurrency na one way youth take dey see food chop, if them ban Binance, imagine how many youths using P2P to see food wey go dey affected.

Binance P2P been help wella even when CBN been dey worry people wey use cryptocurrency. Naija people were still able to exchange, do business overseas and this help plenty people make a living. This will be very painful if government come ban Binance for Nigeria because plenty people wey create account for Binance used their BVN or NIN to do KYC verification.  So if government ban Binance, them no go get access to these portals and there are other ways them go mandate Binance not to allow Nigerians use their exchange as e suppose be.

My people how una see this matter?

For those wey wan read the news in detail, Peoples Gazette carry am.