Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: This idea go reduce our daily expenses.
by
rachael9385
on 09/08/2023, 18:24:46 UTC


My brother this bike fine and e dey economical also and if you check the price too e dey fair. I no know which country you wan order from and the importation fees. My major  challenge for this bike be say e fit make you dey stranded because the battery wey you charge fit finish unexpectedly for middle of road. Just like if petrol finish you go enter filling station. But for charging, e fit hard because normally light sef no dey Nigeria like that.
If you look am you go under say the country dey connected for suffering. Light sef no dey, petrol come expensive and people are looking upto gass now.
I know everyone has there own points but come to think of it okada man tire dey less for road and en dey push am go volcanizer abi? And fuel dey finish for some motor the owner dey push am go filling station Shay? So even if the electric bike battery off for road we go still push am go our house nah naija we dey, the only way to overcome this situations nah to dey very observant to the battery percentage and make we calculate the distance before we move go any destination, So my brother that one no be issues.