Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Still a newbie/novice.
by
Nheer
on 11/08/2023, 19:56:22 UTC
Good morning to you all my naija people. I registered a year ago but couldn't meet with all the forums activities due to Ill health I was battling with for 9 months. But am better now and am seeking all your support in guiding me through the activities of the forum so that I can succeed like all of the great minds here. Thank you all. Humbly waiting for your guidance please
You are very welcome and i am glad you are now feeling better. The forum na just a discussion forum where you go learn a lot about bitcoin and cryptocurrency and e get rules just like every forum de get and as Charlse-Tim and others don tell you just try make you follow the rules wey de here and gradually you go understand how dem de do things here. But the way you talk am say you wan succeed so, this place no be school or where dem go fail or pass person, na just discussion forum where u go just de put mouth and add to discussions and when you make better post any body fit just reward u.

My advice be say make u no put am for head say you rank up just take your time de follow up discussions and with time you sef go sabi and as u de drop quality post u go begin de grow gradually.