Just this morning I watched one
video for social media way one guy dey advertise electric bikes and I con like the thing way the guy dey talk about so I say make I carry am come this our local board for this forum because nah only us nai know how e take dey for our country.
This electric bike we fit carry am go work, strolling and even go markets to buy something's, you fit still even use some carry somebody and e dey easy to drive just like the way gasoline motorcycle dey, now way the price of fuel dey up if we get am e go reduce our expenses small nah just to charge the electric bike that's all but you go need engine oil, but that one nah once in a while, I see the one of $300 and I try to order am online
The idea no bad but you dun reason where you go dey charge am and how much electricity wey the bike go dey consume. E fit cheap now but you dun reason how the price go be when the demand for the bike begin dey go up and what about repairs. We know say this bike never they plenty for market so mechanic wey go dey work am no go be anyhow mechanic and na cost dem go dey cost. Me I for recommend bicycle and I mean manual ones as na dat one for sure pass because as you dey use am na so you dey exercise at the same time.
That guy ola of Lagos sabi advertise things wey the average man no fit afford oh so this one wey you dey send us go over their that one mean say na big bucks we go dey pay. Also wetin be the guarantee say this bikes dem no go spoil and as you buy am if e spoil dem go change am or repair am for you. Also as you dey buy you need know say nobi anyhow road you go dey carry am go make people no optain you collect the bike form you. You need dey mindful of who you dey use repair the bike because any small thing wey dem no repair well fit make the bike dey worry you.
Overall e go dey economical but nobi everywhere you go carry am go, maybe all this small small waka wey no far na where you fit dey carry am go because this kind things go dey draw careless attention to yourself and people fit dey target you.
My boss good day sir.
This charging aspect no be too much issue because no how way we no go charge an, like this period we get charging centers were we dey fit charge our cellphone and accessories we fit charge am there, and we fit still get light for like 2 to 5 hours and I sure say if we charge am for eight hours the battery go dey full charge, if at all say we dey go somewhere with the bike and the battery runs down, the bike still get pedals way we fit still use ride am as bicycle and e dey very soft and still get gears, the reason why the electric bike get this pedals nah because if the battery finish for road we fit you the pedals ride am like bicycle go back house or were we go charge am.