If government like make them listen to those Bureau De Change people wey said make them ban Binance that one na there problem because Binance has come to stay we go still dey use VPN run am thank God say transactions na anonymously, trust Nigerian youths now them know how to bypass anything, wetin consign Binance with naira depreciation and loss of value instead of those Bureau De Change operators to digitalize their operations using P2P make them enter competition with Binance they come dey talk rubbish, they no reason am when CBN announced floating of Dollar against Naira which cause naira to start falling because we are important dependent country.
I think if government ban Binance, they will be mandated to stop Nigerians from using their exchange. Unless you never used Nigerian documents to do your KYC, that is the only way you can use the exchange. Our hopes and prayer is that they should not ban Binance....
Guys dis matta strong oo. Bureau De Change e no see any other thing to do again na Binance wey e no do dem anything n dem wan ban. I also laf at dem. Me I strongly believe say for dis Oga Tinubu adminstration, e no go happen, Tinubu e no go listen to dem oo. Dem go try but e no go work for dem. Na jealousy dey make dem dey tok dis kind things wey dem self no say e no go work. Tinubu likes good economy plan and not all these nonsense wey Bureau De Change dey vomit from their mouths.
I don't think Binance can be ban in di country again because the first attempt was failed when Nigerian SEC says day Binance dey operate in di country illegally and till date, me, I don't know how dat matter was solved. I don't know why binance became a threat to Bureau De Change, I believe sae Binance dey do well pass dem so dem want to remove it and take over but dat one e no go happen again. Let Bureau De Change do well in their services like Binance then do competition will just start.