Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Could bitcoin help Nigeria falling economy
by
Mate2237
on 16/08/2023, 06:08:08 UTC
If Nigeria where to accept bitcoin as its national currency would this help our country's current economy and how
You dey welcome. You na correct newbie u bi. U no bi alt-act because as I just see ur writing method nai I just know sae u are olodo for di forum, and one thing I go advise you be say make dey read Oda people their posts and comments, and obey di laws of the local board and the general boards and try to post quality posts so go dey go up small small. And make you no do copy and paste work (plagiarism) for here because na straight banning be dat one. Please always ask your mentor anything you no Know and also ask for here for more knowledge. Make u dey read more dan posting.

And di question u asked, if Nigeria adopt bitcoin as a legal tender in the country, e go help the economy, because the devaluation of the naira sef go reduce and bitcoin be sae nobody go fit devalue am Instead im go devalue dollar. Naija economy go good because many people go use bitcoin dey do transaction of buying and selling of goods and services, and people like us will not sense local currency again unless we want to buy something that very important with Fiat Currency. Bitcoin go help naira because bitcoin is a decentralized currency for internet. And when plenty people abandon the use of naira to bitcoin naira will just have value.