Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: USDT better pass domiciliary account
by
Sim_card
on 18/08/2023, 16:50:57 UTC
As we dey see our naira dey drop the symbol of our currency just dey dey worthless every day many people won turn to foreign currency at all cost and the way to do so for this country na to have domiciliary account if you one leave your money for bank or you fit use your niara go buy US dollar keep which I no advice, it's risky keeping money especially if the money dey huge.
As long as na dollar you dey keep no be Naira,the money go dey increase in value as Naira dey depreciate. Instead of keeping huge money in the bank why not buy bitcoin and use it as a store of value.

I come reason say it's not worth the struggle and time and effort, and e just be like say I don give my money to the government and them fit freeze am anytime they want.
Who tell you say government go just freeze people money like that without you committing a crime that can lead to the freezing of your account. Domiciliary account just dey like our normal bank account wey we dey keep Naira,but the difference na say you go dey keep foreign currency like dollar, pounds e.t.c. So government no get any right to freeze anybody account abi government do freeze your bank account before ?

So in comparison to domiciliary account based on time, effort and potential of losing your holdings I suggest using stable coin than having a domiciliary account in Nigeria.
It is not true. Domiciliary account sure pass stable coins for Naija,if anything happen to your funds in your domiciliary account, you can hold your bank responsible and you will get your funds back. If stable coin tomorrow crash and you lost your funds,where you won go hold the dev to pay you back your funds,for America or where.