My people e just come to my notice say unemployment for don reduce for naija if many people were educated and informed about Bitcoin. There is a saying that Education is the key to success. But people wey no go school dey See who go school as a waste of time and effort because of hard economy. And tag it "school na scam".
Not entirely correct. If you don't have industries and an enabling environment for companies to thrive, even of you like get phd for bitcoin, you go still dey unemployed. That is if you define unemployed as the one wey person dey go office work for pay. Or are we going to call a young Nigerian who has taken up bitcointalk as a job, employed?
School no be scam. Who no go school don scam himself ful time. I dey always talk am say the C.E.O of Facebook (Mack zugarberg) for don rich pass as e dey now if many people been go school.
In a way sha, school na scam. The four or five years wey some of us use go school, then come comot do one year for NYSC, then still stay another 1 or 2 years before we get 80k per month job, if to say we use am learn auto mechanic, Pipe fitting, spare part trading, fashion designing, we for don turn professionals and even dey employ pipo. If na lie, go Onitsha Market go ask those big igbo men.