Well done Chief.
All of us get different ways wey we take see the forum and our reason for being here. And na only you sabi wetin dey your mind wey carry you come here. I nor go lie give you in as much as say we get Naija board here, the truth be say na all man for their self o. Na only when you don carry yourself well before anybody go look your side. Like Charles don talk already to get merit if na wetin you mean by your post dey very easy. You gat read inside and outside the forum wella. Your aim na to pass better information wey make sense or ask or answer people questions well too.
Lastly make you nore fear newbie today go turn Legandary member tomorrow ...na just hardwork and time e go take.
Doh.