My people I done come again o. Life of a newbie can be boring at times😄😄. but the question be say how ona wey be legendary/oga dey carry newbies along. because I see say ona dey always ignore new menbers. Naso ona dey do? Ona go push person enter front come leave am behind bars.
I dey beg ona make ona dey carry us along o. I no say wen ona dey see wetting we dey talk e no dey make sense to ona but make on dey try dey see us because naso ona Carry start. If na lie I dey talk just reply me and see weting Dem go talk.
Usually you no suppose wait make person marry wife give you and also come in-pregnant am give you again so that she go born give you the baby, like the wey i dey post here after i join this forum na so my case close and really hard be say me no too come online to come post for almost one year but na so me come back dey begin deep my eyes to read post.
Normally for you to succeed here or rank up, you must leave any other work and any other bad news that will distract you from focusing to read things here then recreate your thinkin faculty and know that anything is possible. If you are having this mindset of becoming Legendry overnight know that is not possible because you must pass through stages, na so every single person pass here including me wey dey talk like, try to read wetin others talk and involved your self with serious discussion.