My people I done come again o. Life of a newbie can be boring at times😄😄. but the question be say how ona wey be legendary/oga dey carry newbies along. because I see say ona dey always ignore new menbers. Naso ona dey do? Ona go push person enter front come leave am behind bars.
I no dey sure say high rank people wey dey here dey side line anybody, anything wey u need if u ask, people dey here wey ready advice you on Wetin u go do, but if you no ask nobody go know Wetin u need, nobody go spoon feed u for here ooo, na only support you go get from here which am sure everybody wey dey here ready to support you. So I don’t know Wetin u mean by dem dey ignore newbies and dey go push person go front come ignore d person, me self na newbie I be before, and people really help me here, because I share informations here and anything wey I need I go also ask and people dey answer me, atleast I dey grow now and dis local board contribute.