Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: WE RISE BY LIFTING OTHERS
by
sokani
on 29/08/2023, 17:58:11 UTC
My people I done come again o. Life of a newbie can be boring at times😄😄. but the question be say how ona wey be legendary/oga dey carry newbies along. because I see say ona dey always ignore new menbers. Naso ona dey do? Ona go push person enter front come leave am behind bars.

I dey beg ona make ona dey carry us along o. I no say wen  ona dey see wetting we dey talk e no dey make sense to ona but make on dey try dey see us because naso ona Carry start. If na lie I dey talk just reply me and see weting  Dem go talk.
I kno say you we all need merit to rank up but my advice be say no carry am for head like gala if not you fit put yourself for trouble. Just take your time dey read and make positive contributions and di merit go come. Make I take Charles-tim do example, if you look through him first 100 posts wey him make for di forum and him recent posts you go see di wide gap in knowledge. E no just happen by chance, e happen as a result of reading and hardwork.

According to one of BrainBoss post wey him talk say reputation matter for di forum and na him dey very correct and I no need to go into details. You fit build a reputation here, if you wan learn skill or e get person wey you dey look up to as a role model, you fit reach out to di person and I believe di person go dey kind enough to guide you. Me sef dey learn too, so just take am easy dey go through di learning process.