Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: WE RISE BY LIFTING OTHERS
by
Asiska02
on 30/08/2023, 21:54:54 UTC
My people I done come again o. Life of a newbie can be boring at times😄😄. but the question be say how ona wey be legendary/oga dey carry newbies along. because I see say ona dey always ignore new menbers. Naso ona dey do? Ona go push person enter front come leave am behind bars.

I know d angle wey you dey come from and wetin you dey yarn about but no be d way you dey reason am e be before. When we come here, local board no even dey wey you go take know your fellow naija person but tinz don easy now as you sabi your country people for the forum and you go get brotherly guidance and advice from here.
Wetin you need do from your side na him be say make you get d mindset of building yourself independently and no depend on anybody for your growth here, with that, you go reach greater heights and move up ranks faster. This go fit dey achieveable with quality post and continuous meaningful contribution to the whole forum.