When i dey read some people post the thing dey sound me like sey Dem they speak correct English but this our local board na pigeon English wey dey us talk here, make our people dey use pigeon dey talk here so that wey from naija go dey understand weitin we dey cap well well, if we wan use english talk, some oyibo dey read we dey talk and some of Dem dey watsup when we talk, so is good make we make sure sey the tins we talk e plenty for our pigeon pass the one wey we use corit English talk, this Tori wey I come tell my brother's and sisters wey there. Another tin wey dey important we wey naija people suppose dey do, na to help our country people make dem grow becuz na una people go still help dem to grow, we no go expect make person wey from another country dey carry una brothers and sisters along, make una dey try dey show love the wey brainboss dey show people love for the community, make una know sey injury to one is injury to all, and when we urinate together it will come outside foam.