Nwada001 my broda, I been dey read your comment nai I con dey ask myself, na Nwada001 be this? No be Naija pikin be this? Or here no be the Naija LB wey I know again? Where the plenty grammer dey fall out from nah eh my own Nwada001? Easy with the Plenty English nah, make we dey represent oh.
My broda no mind me, diz days the way I dy waka for the forum anytime way I get small chance I no they even remember when I don reach our local board and when I they for public place again, how me I wan carry leave to they yan language way I dy carry do conductor work for Ptakwa here? Sometimes kwanu nah the thread way person they meet to comment on here they kukuma confuse me way go come make me forget to talk with my normal pidgin way I carry for mind come dy speak Watin me self no no, when be say nah the pidgin be among the things way they carry me come diz place.