All those ones no supposed dey concern you because if you no plan bad for others God no go allow bad plans spoil your own show. Just dey do ur thing dey go and they hustle ur hustle legitimately and when na ur turn to chop, everything go begin fall in place. People go always wish you bad because no be everybody dey like when person dey chop pass dem or their own no better and the other person dey get grace like say na him papa get better tomorrow wey we all dey find so. Na we Africans too dey believe all dis bad relative talk because of too much films and stories wey we dey hear and no even know if dem be true. I hope you know say wetin you dey think na wetin ur brain go believe and everything go begin dey fall in line with wetin you dey think, sometimes nobody dey do us but we na our thinking na wetin dey us and negative energy just dey complete the thing for us.
Boss

juju dey for real o but the thing be say make evil eye people no focus attention on us. The only weapon we get na prayer if not things dey happen and no be film or negative mind but if you never witness some things you no go believe say things dey sup. One thing again be say success dey waka hand in hand with time and no be by who hustle pass because people dey hustle for here day and night and door never open. If God don show you way and open your door, e worth thanks giving. As you talk am na so e be because if you give up na you lose because you no go sit down make your time com meet you, na you go stand up go meet your time and allow God to his wonder for you.
The God thing about we Nigerians be say we are very strong people who dey do things with determination but internet dey give us bad name all over but the truth be say we no dey give up easily. As long as we no spoil person own, I pray make our own no spoil and make God wisdom continue dey follow us up and down.