This is a serious issue because everyone now wants to move to areas where they don't experience floods. The landowners are increasing their rent in those flood-free areas. Acquiring land there is now outrageously expensive
You sure say this statement truly represent wetin dey actually happen because from wetin i dey see for my own state na places wey dey get flood wey even dey get people attention like the GRA or other areas wey estate dem plenty. The thing be say na those areas get the finest houses and since na well plan areas in regards to the building dem, d houses dey cost and people still dey relocate still as light, security and comfort dey full those areas. Na where flood dey wey no get name na where people dey run from but you see all those big man areas dem people still dey pack go irrespective of the flood. Which dey wey news come out say lekki flood wan finish the place yet na where still dey sell pass for Lagos be dat. And as for people benefiting from it, the truth be say any bad thing wey dey happen for this country, e get people wey dey benefit from am because if dem no dey benefit, dem for dun find way solved that particular problem since.
What has caused the increase in disastrous floods, and can't the government do something to mitigate the issue?
The main cause of flood na lack of proper housing plans, people dey build build block all the waterway dem wey we get and dem no dey even create better channel wey the water go flow enter rivers dem. This is the reason all this swampy areas wey estate dem dey buy or governments dey buy and sandfill to use do their GRA dey always get flood issues because of lack of proper drainage system. Assuming when dem dey do road, dem dey dig better gutter we for no dey get this flooding problems but because people dun build house cover the normal root wey water dey follow before na wetin dey mostly cause this flooding problem. Also the dam wey Nigeria suppose build wey dem never build dey also contribute to why the river line areas dey suffer for this flood matta.