Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Easy to say but hard to make it real in the future.
by
CryptopreneurBrainboss
on 12/09/2023, 22:42:28 UTC
I was told that some people have been holding BTC over 7 or 8 years for the price of BTC to reach a particular price of their choice before they can sell, does it mean they don't have issues to solve by selling their BTC? Or they have other way to get the money to solve the issues without selling their BTC? because it hard me to hold long like one year when there are some important things to buy.

Dem talk say dun put plenty people for problems wey dem no expect, no go dey follow wetin dem talk take dey live your own life but do wetin go workout for your. Wetin happen to you na wetin dey happen to many people wey invest inside bitcoin and wetin dey cause am na lack of planning wey dem no get. When you dey invest inside Bitcoin, no go pack all ur money take dey invest or you go see urself for this kind situation few months later. When you wan invest inside bitcoin, time your money well. Keep savings one side and also keep vex money wey you go use Incase things no go as you plan dem and that spare wey remain na wetin you go invest. I know say dem say make you invest before you spend or chop but for crypto here because of how volatile wey d market be, e better you no go carry all your money take do investment.

Not that I don't make profits when I hold, but to hold for that particular price to come to pass is the major challenge to me, can you share your idea on how to make it real in the future for that your target price to come to pass, so that people that are facing the same problem like me will learn.

Invest only money wey you no go reason for a very long time na the only wey to reach this target wey you dey find so because when you invest only money wey you no go even know say e dey for investment, you go fit forget about am for Bitcoin until e grow fit give you better turnup. Make I use this example give you, make I say you dey chop #100k monthly for salary, you fit dey invest #10k monthly for Bitcoin. You see dat 10k wey you dey invest, you no go reason am because na chicken change for your salary and when you do am for 12 months you dun invest 120k so and you go get cash to handle other challenges wey come your side but you see person wey dey chop #100k go invest #50k  or even more just because him wan chop quick money, na dat kind person go enter this your situationship. Dey invest only your spare money and you no go enter this problem again.