Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 1 from 1 user
Re: Easy to say but hard to make it real in the future.
by
Kelward
on 15/09/2023, 07:48:30 UTC
⭐ Merited by hugeblack (1)
It is better to sell your bitcoin if you are in need of money. Just be hopeful for a better future. You can not have money and be borrowing

Na matured advice na im you give di OP, because na who de alive and wey no get high blood pressure, na im go live to enjoy return on investment. Di reason why we de invest in bitcoin or any oda businesses na to make profit and conveniently spend am on our future needs. Aldo we fit plan say make our bitcoin investment accrue plenty profit before we go sell am, but e get di kind emergency need wey fit happen and wey go require urgent money to solve am. In dat kind  scenerio, if no oda possible means de to raise di money, di wisest thing na to sell dat your bitcoin sharpaly to solve di important and urgent matter.

Aldo I feel say to borrow no bad if person get a reliable source of income to repay back, so far say wetin im wan use di money do de reasonable, unless say im no get hope of repayment Diafo you e no de necessary to touch your bitcoin investment, wey you never plan to sell, to sell am and solve problem, when you get alternative to raise from oda sources, including borrowing. To sell di bitcoin solve problem suppose be a last option wen oda means no work.