Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 5 from 3 users
Re: The high cost of living in nigeria.
by
Ruttoshi
on 20/09/2023, 17:10:56 UTC
⭐ Merited by Marykeller (2) ,GiftedMAN (2) ,Mia Chloe (1)
the government needs to start from somewhere because the masses are suffering much and this might cause more insecurity is not handled very well.
You sure say the government know where to start from because me I see them as confused people with no agenda for Nigerians. The way things don be for the country presently, na only you fit help yourself find wetin you go fit use fey earn a living. This is why learning of skill is important because many people will need your service and this way you go fit use am dey survive till you hama, because me I believe say God no put our future for these leaders' hand, If not nobody go make am, with the way wey them dey mismanage our resources.

Nigeria is not a country that supports manpower development or wey dey appreciate your gift and talent because these wicked leaders no want make poor man pikin dey rob shoulder with them at all. This na why them dey do everything to choke poor people them but the truth be say God na him get power pass them. Any Nigeria citizen that can survive in Nigeria, will surely make it when he travels to overseas because of the lesson wey suffer don teach am.