4) Bitcoin adoption/acceptance: since Nigeria economy is very weak, therefore, accepting Bitcoin will sustain the economy to some extend. In fact Bitcoin will boost the economy in the country, it will even create employment and self reliance of the youth.
Difference dey when you say Bitcoin investment and Bitcoin adoption, Bitcoin no be wealth creation tools wey you go think say immediately you accept am say all your problems are solved. Nigeria accepting Bitcoin no do much for the economy of we never resolved wetin dey truly cause our economy to dey dis poor which is bad governance. Just because Nigeria accept Bitcoin no mean say everything go begin work for the country. If you reason am well, e fit make things worst because the stealing go dey so fast and decentralized wey be say you fit no catch person wey steal am and people no go dey fear to thief again as mixers can be used to mix the money and we no go fit track am to the stealer address. Nigerian youths na hustlers so dem go always find way to chop and investing in Bitcoin na one way to chop well tomorrow.
Yes, my oga @ryptopreneurBrainboss, you talk true talk for this matter, we know say as this country dey so, if the government make bitcoin investment legal tender for the country e go help many citizens mostly the youths but that one no mean say the country economy go good just in a twinkle of an eye.
As we all already know how the political system they very corrupt even if we as citizens try our best to change some kind things, e no go show say we done try our best because as the youths they rebrand things, the government they spoile am, so the thing be say the Nigerian governments go first make change as them promise us before, then things go change for good, then if them accept Bitcoin join things go con change ASAP.