~snipped~
~snipped~
I take my last muscles hail una. Una too much. The only gbege wey I see for wetin una do be sey una use English write una yarns. For here, we nor dey use English drop proverbs. Na strictly pidgin things here but you fit explain d proverbs for English. Na so we dey take run am here. Una go try adjust.
My chief your observations dey always dey legit and I dey also like the way you dey advice and encourage the younger elders dem wey dey gather here you do well Baba.
I get small thing to add here based on wetin you don already yarn, abeg help us address this matter so that new elders wey dey come dis we corner go notice am, make dem try dey read the previous proverbs before dem drop new one because the proverbs wey Dobabe and Roseline492 drop don already dey for here I understand say dem no no.