Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 6 from 3 users
Topic OP
Will Bitcoin have a chance in Nigeria if?..
by
Majestic-milf
on 28/09/2023, 15:23:58 UTC
⭐ Merited by Zigabel (3) ,hugeblack (2) ,CryptopreneurBrainboss (1)
 I don dey reason dis mata of Bitcoin in Nigeria and the way Govt dey make usage and operation a bit difficult and I come dey wonder weda e fit get a bit of breathing space if some of the big players in the business world pick interest in investing in them.
  Una go agree with me say naija no dey completely against cryptocurrencies, Bitcoin especially but them no also dey friendly but just like the way El Salvador and Central African Republic take bold steps in making am dia legal tender, una feel say government fit relax some regulations on am if big cats for the business world like Aliku Dangote, Tony Elumelu and others decide to add Bitcoin investment to their portfolio?
Although this news nah old one oh but Nairametrics believe say Dangote for be the 6th richest man in the world if say him bin invest 5% of him moni for Bitcoin. And I know say e no too late.
 Another reason wey make me reason this mata say none of us be stranger to how fast the naira dey depreciate sharparly against the dollar and currently, 1dollar to naira for black market nah #1,009 as at time of writing and if we big ogas them fit do something, maybe e fit push the president to rethink him stance on Bitcoin because we need something wey go help our economic situation and so far, Govt seem to be running out of ideas.
 How una see this one? Make we yarn.