Dis new thread dey self moderated to prevent spam and scam like activities. I promise say I no go misuse am, e go only come into use when na for the betterment of the community.
To avoid newbie welcome thread spam, use this thread use introduced yourself. Ma people I greet una oh, this thread wey I create like dis na for we to come together and welcome every newbies from naija wey join us for this board. No shy here oh, just dey free discuss everything wey you get for mind for here, if you get any questions we dey for your mind, just ask.
Make we just try our best to obey every forum rules read;
Unofficial General Guidelines For Posting( Na de koko dem) by Igehhh
NOTE:[1]: No go dey trade with another person you just meet for here unless you trust them and all trade related transaction, carry am go
Marketplace board and child boards for transparency.
[2]: Official language Pidgin & English.
[3]: First timers (All newbies) abeg just introduced yourself so we fit relate weller
- Username:
- Gender (optional)
- State of resident (optional)
- Skills (Dis one dey important oh incase person dey find person like you we fit recommend)
Note: This thread now serve the purpose of welcoming new members to the boards as all assistance and questions can be asked here. Avoid discussing off topic discussion or they'll be deleted. Only welcome users, guide them, answer their questions etc on this thread.
Thread will be updated regularly and improved as new things are implemented.[/list]
I dey happy say people wey dey ready to help their fellow country men wey dey new for this industry dey. Make Una continue this good work as we need one another to succeed in this critical stage of our economy.
Make we be our brothers keeper and make sure say we elevate people through this platform. Imagine where many people come become baba for dis industry you go see say the rate of crimes go reduce well well and we go dey happy for each other, I thank you my fellow compatriots