Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Religions dispute in Nigeria
by
CryptopreneurBrainboss
on 29/09/2023, 04:51:29 UTC
My country people I greet una ooh, sometimes I can't help but wonder how good or bad Nigeria would have become if we had just one unified Religion in the country, we have Muslim and Christian religion, and the conflicts between the two religion is something else,

I guess we'll never know because it can't happen, we no fit get only one religion for the country. Nigeria dey too diverse to have only one religion but e no mean say we no fit dey in unity in our diversity. Na lack of proper education dey cause all this problem wey we dey get because when we dey intellectually equip we go understand say e no matter who you dey worship but the good in you dat's all that matters. When we dey educated, we no go allow politicians use religion to divide us because na wetin dis politicians dey do so to get favor from people wey from their religion. Religious diversity na wetin most countries for the world get but because their level of education high, they're coexisting well without much challenges, Nigeria can achieve that as well.

Quote
But I believe if the country had just one unified religion things would have changed a but. So my country people make una reason this matter how e for be if to say we get one Religion.

I no support am as e go limit us to only one way of thinking, there's strength in been diverse. Islam and Christian religion no be even our religion so why we go accept only one, we get our traditional religion and other religions that are peaceful. No be say dem popular go make use think say they're better. We get Hinduism, Sikhism, Atheism, Buddhism etc dem many and accepting all legally go do more good then banning others and only accepting one, e go limit our thinking growth. Imagine not allowing gambling in the country or alcohol because of religion why go make all this company leave the country and e go take us back in civilization.