Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Why E Go Be Prayer?
by
Majestic-milf
on 29/09/2023, 08:39:20 UTC
Naija nah the only country wey need prayers as e be. Wetin  presido don do to make change happen in a positive way?
Naija no be d only contri wey need prayers. Other developed countries need prayers too but e come be like say na our own worse pass unto say on a daily mata dey worse. E bad say we dey para say presido dey ask for prayers for the contri wey nah  still some pipo wey sell their votes to person wey don old sotey e no fit even accurately call the name of him party. No offense to the president but him no fit operate like Joe Biden even as him dey claim say him dey younger than the American president.
 We dey always complain wen president give less than satisfactory suggestions and/or replies e no sopoz affect us again as no be now such a thing don dey happen. And for the fact say Op dey para just shows say somehow him still believe say the president fit change things. My guy abeg wake up!