Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Why E Go Be Prayer?
by
Abdulzuruku01
on 30/09/2023, 06:27:27 UTC
My fellow brodas and sistas, I salute una. Abeg wetin we no go hear for this country as we dy so? Our presido com out say make we pray for the country as e be so, I no understand again. Nah any president wey enter sit go say make we dy always pray for country we them don use their hands spoil finish? Or them no know say people don start this prayer for long? If them dey chop the money them no go ask us to pray so how this prayer wan take help us? Naija nah the only country wey need prayers as e be. Wetin  presido don do to make change happen in a positive way? We go dy pray for better for the country them go dy make life hard for us, see dollar don climb skyscraper and I believe say some of us dy follow the raise of am so with all this things and some other Yama Yama wey dy go on for this country e still make sense as president talk say make we pray for the country? No be say e no good to pray but our presido need to remind us?

Abeg make una talk something, cos me I weak like this for things I gather to talk... Good morning naija!!!

You know prayer na em be the solution to any situation we see ourselves. And no be sey all the presidos wey we don get for this country get intention to do bad things, some of dem good but wetin dem dey use dere eyes see for that position no be moi moi.

For presido Bola Ahmed Tinubu go show for public sey make we prayer for this country you go know sey he don use his eyes see shege. We all know sey the man na big name for this country, but people wey dey spoil this country they inside aso rock and dem no dey ordinary. So make we try pray as he said the story fit come change and if we sey we no pray na we go still see shege because the man go still contest for second time and nothing go stop am from winning and the shege for second tenure they always come with firewood from hell fire. So as e be now ehen prayer na em be the key..