Our people say if snake don bite you befor if you see long black rope you go run without person tellin you to. And for this tori INEC na be the snake while Nigerians na be the befor beaten victim by the snake.
Source:
https://twitter.com/MobilePunch/status/1707321146410938423?t=_z7bXaJHPXads3wyAWxhqA&s=19
As Kogi, Imo and Bayelsa states elections draw closer INEC don dey lament say voters no even send to com out colet their Parmernent Voter's Cards (PVC's). And the headline com sound laughable wen I first read am but then at same time com send strong message say we Nigerians no longer get faith and trust for INEC. Meaning say, INEC no get beta reputation to stand on base on how dem use their own hand assist rig the just concluded 2023 general elections for we country.
No body wan waste their energy, time on sumtin wey dem know say las las e go end as selection process by INEC wit support from the bastardized court processes and judgement. ( He popular slogan: if u don't lik it go to court).
Many many people for social media don dey even say as INEC don destroy their credibility wit their own hands PVC, BVAS, IREV all don turn useless bcos INEC go still announce results in favor for who dem want as winner.
How una see dis matter. Is it possible say INEC fit redeem the trust people bin get for dem thru dis Kogi, Imo and Bayelsa states elections by doing the right thing as what ought to be? Or say na just same road dem go still take as dem do for the general elections? Abeg share ur thoughts with me!