I the see people dey comment dey make posts about how bad the economy and country dey and some people dey even tok say nothing gud go fit com out again despite whoeva becom presido for we nation Naija.
a lot of tins just the make us loose focus on seeing say the beta change we dey cry and pray for e dey our hand and na only wen we Nigerians don really ready to take that change into our hands by all means necessary na then we fit start to see life for inside the Naija but till then na just so so from one level of sufa to anoda we go dey face till we decide to ready for de new beta change we de find from we gofment.
I know my country people, the typical Nigerian wen him put him mind in to do somtin he dey do am to the fullest to make sure him get wetin him dey hunger for. make we use cryptocurrency lik bitcoin for example. see as Nigerians enter the crypto market one hand inno even tey sef naw na we dey front for Africa and even for the world if them dey tok about 10 countries wey citizens dey actively involved for crypto Naija go follo for that too 10, na bcos we put our mind wit hunger to do well.
Na with same energy too if we all don really ready for a new beta Nigeria inno go take 2secs we go get the results coming. Na the powa of Naija be that but plenty of us neva start to mk use of that powa wen it com for gofment and politics na why we country Neva be as we want.
you sef reason am!
My big aunty this contri get as e be like this, we dey fight for a better naija but nothing to show for, if we use protest like the end
End Sars own nah kill them go kill us and them go label us as criminals. This whole thing about beta Nigeria nah very hard process oh, make we no see am as one easy something, because the division is too much and for me oh the best thing to do first nah to get one voice without that e no go easy to get a better Nigeria.
The division among us the ordinary/working-class people for the country nah one of the big problem to why I say we never really ready for the new beta Nigeria we dey pray for. For this country we go dey claim to fight and clamour for a beta Naija but yet we no get one voice bcos every small matta na dat time everybodi go rememba say him na Ibo, de other guy na Hausa nd de next man na Yoruba, Ijaw etc, no bodi go even reason am say we nah Nigerians and nah under dis division dis politicians dey take defeat us everytime we try to rise up against their wikednex towards us.
As for Endsars matta, dat one na just a piece of the iceberg, if only we knew de amount of fear we laid on the mind of these politicians during that failed revolutionary test called Endsars aswear we Nigerians for don pull anoda hit beyond that one again. Beta tins no de com easy and immediately.