Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Government Really Value Our NYSC?
by
Kara3
on 04/10/2023, 11:30:21 UTC
Is quite unfortunate say this kind tin happen to dem, in terms of security e no easy for any country in the whole wide world, no be say the government no dy try, dem dy try, but e no dy enough.

U know say as tins dy upgrade, na so criminality dy upgrade, e dy more hard now to clamp down most of this criminals now because more educated ones dy among dem, dem dy do more of thinking now than before, some of them dy out think our security agency, if anyone go fit run better Intel wey dem fit use catch dem, because as long as security is concerned, information na d key, as for now, na just hope and pray for better Intel from community wey d kidnapping take place.