I the see people dey comment dey make posts about how bad the economy and country dey and some people dey even tok say nothing gud go fit com out again despite whoeva becom presido for we nation Naija.
a lot of tins just the make us loose focus on seeing say the beta change we dey cry and pray for e dey our hand and na only wen we Nigerians don really ready to take that change into our hands by all means necessary na then we fit start to see life for inside the Naija but till then na just so so from one level of sufa to anoda we go dey face till we decide to ready for de new beta change we de find from we gofment.
I know my country people, the typical Nigerian wen him put him mind in to do somtin he dey do am to the fullest to make sure him get wetin him dey hunger for. make we use cryptocurrency lik bitcoin for example. see as Nigerians enter the crypto market one hand inno even tey sef naw na we dey front for Africa and even for the world if them dey tok about 10 countries wey citizens dey actively involved for crypto Naija go follo for that too 10, na bcos we put our mind wit hunger to do well.
Na with same energy too if we all don really ready for a new beta Nigeria inno go take 2secs we go get the results coming. Na the powa of Naija be that but plenty of us neva start to mk use of that powa wen it com for gofment and politics na why we country Neva be as we want.
you sef reason am!
As this country dey na cruise full am as we take dey face a lot we still dey use cruise hold body make country no bard we still no come make our self happy. Waiting i dey try talk be say when it comes to matter like this to make our country better, yes i know say we the youth fit do am but in that case we no dey ever know who serious with issues like this until person die before we go start to dey shout say we want better Nigeria. The reason why everybody no want to focus on how this country go better everything happening in it tired us, that is why we go see say everybody they fight for himself not the country, you can see even small children wey just dey grow dey complain about this country, no be our faults na waiting the government make our eyes see dey make everybody dey fight for himself, we no fit kill ourselves for country wey no hear our cry.