Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Government Really Value Our NYSC?
by
Gozie51
on 04/10/2023, 15:21:16 UTC

I still dy ask, e really dy comporsary to go serve still come out to continue dy suffer as if them do wrong for the nation?
No work instead nah hustle wey no dey related to wetin these our brodas and sistas go school for, e make sense?

Make I pause here, make una talk something for this matter...

Make I just put small mouth here. My brother, the thing be say government no want stop the program and as them never stop am, well it is necessary to still follow them do am as a graduate because na still one of the things to show say you go tertiary institution, e get the kind work wey dem go still require you to submit discharge certificate, although I still know say for naija money or contact dey do everything but you wey no get all those, collect your discharge certificate or if you no want go then apply for exemption letter.

The thing be say for me NYSC don outlive im value. Since 1973 wey Gowon establish am after the civil war, them still dey feel say e dey create unity but we all know how realistic that assumption dey.

Some members for national assembly don be create bill to abolish the program but e no go through. For me make them scrap am then gather the money wey dem go pay corpers each for that 12 months then carry am give each person make dem take help demselves. That go increase SME small even say electricity no dey.