Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: We Nigerians never ready yet for a beta new Naija.
by
Y3shot
on 04/10/2023, 19:00:30 UTC


I know my country people, the typical Nigerian wen him put him mind in to do somtin he dey do am to the fullest to make sure him get wetin him dey hunger for. make we use cryptocurrency lik bitcoin for example. see as Nigerians enter the crypto market one hand inno even tey sef naw na we dey front for Africa and even for the world if them dey tok about 10 countries wey citizens dey actively involved for crypto Naija go follo for that too 10, na bcos we put our mind wit hunger to do well.


We Nigerians we be one of the most intelligent people on earth and anything wey go make our life better we dey do am with all our strength. Because of the way our currency dey lose value many of us Don gather dey build knowledge on this crypto matter so that we fit get small security financially.  We dey front this crypto matter for Africa because this matter Don become a way to elevate ourselves from hunger and stagnation that is to say, we Nigerians get the force to bring anything to the top as long as we put our mid to am. I just dey pray say the bad part of us wey be to completely use something till e go spoil no go come out onto this crypto matter.