I the see people dey comment dey make posts about how bad the economy and country dey and some people dey even tok say nothing gud go fit com out again despite whoeva becom presido for we nation Naija
OP, to be honest, na naija people dey do themselves, gofment get their own for their body ooo, but na still me and you wey dey do anyhow with little opportunity go enter politics do worse tomorrow. For example: person plant vegetable for em backyard, harvest am go sell. Em go sell am cost well well, when you ask am, em go say dollar high. Now how dollar trade affect vegetable you plant for house???. You come bank, if you no bribe security man, person wey still dey sleep for em house when you come bank go first you enter. Gofment dey fuck up, but our own dey our body too. We never ready, change can start from the grassroot.
a lot of tins just the make us loose focus on seeing say the beta change we dey cry and pray for e dey our hand and na only wen we Nigerians don really ready to take that change into our hands by all means necessary na then we fit start to see life for inside the Naija but till then na just so so from one level of sufa to anoda we go dey face till we decide to ready for de new beta change we de find from we gofment.
Bros, when you dey talk about plenty things, start from hunger cuz na em dey distract person very well as man wey no chop belle full, no go even get strength nor reason to change anything. Our government get better strategy to dey keep us hungry, so that if you mistakenly see food chop, you go over happy, E go come be like say them do one big thing for you while them dey kill you.