Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Government Really Value Our NYSC?
by
Asiska02
on 04/10/2023, 22:14:45 UTC
Make una no get me wrong oh, this same people nah people wey as e happen them suppose no carry them play from day one as Charles-Tim talk say if you slap them nah trouble you find, na so people wey dey at the top suppose take the NYSC people.
At least we suppose to dy hear positive news about this matter but e be like say nobody don hear about their abduction, nai make e come be like say nothing happen. Well make we dy see as them go arrange bring them back.

I no hear about any abduction of corp members for calabar if no be now wey you carry d matter come here come yarn. E be like say no many news channel carry d matter up or dem no pass through peeper channel to disseminate the news. Dis matter no dey surprising becos the whole naija dey face insecurity problem and dis kidnappers dem no mind anyone wey dem go kidnap as long as e go fetch dem money. I pray say d government intervene sharp sharp with local authorities to help save d corp members soon.

That Chibok girls matter if you know wetin and wetin dy inside that issue you go know say e get wetin them no want the public to know, them let us hear wetin them want us to hear about Chibok girls own and this one no be same thing compare to the children from Chibok. For me oh that abduction nah political movement against Good luck Jonathan.

If you be Nigerian and you still dey take side for any politician you never know what’s up be dat. The same way you feel say dem do am against Goodluck Jonathan, na d same way d present administration go dey feel say all dis kidnapping na against their own government not to succeed too. Na dem know wetin dey hidden behind dis tinz and make we allow dem solve am dem self instead wey we go dey support one side wey be say dey are all birds of d same feather. And na just opportunity one get above the oda for the meantime. Na just prayers we just need, the days of believing in just a politician to do total just hasn’t arise or is passed already. Na we we get ourselves now to beta our wahala for d country.