Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: We Nigerians never ready yet for a beta new Naija.
by
Nheer
on 05/10/2023, 04:30:02 UTC
I the see people dey comment dey make posts about how bad the economy and country dey and some people dey even tok say nothing gud go fit com out again despite whoeva becom presido for we nation Naija.
If you check well you no suppose blame all this people wey de reason am say naija no go better and nothing good fit comot for Nigeria again no matter the person wey climb that seat because for how many years now we don change president and nothing de really change and the worst part sef be say e con be like things de even worse pass as dem be before. Everytime wey new president enter seat things con de worse pass the last person time. We no fit compare Obadanjo tenure with Goodluck tenure and so we no fit compare Goodluck wey everybody de shout say him no try say him don spoil country with Buhari regime, to me Buhari was the worst of all because alot of people had faith in him they believed so much in him to make a difference but he failed us all.

With the kind shege wey Nigerians don see so far you no suppose blame them when dem conclude say naija no go good again but all we can do is have hope because when we give up on the country it is like giving up on ourselves. Let’s keep trying and never lose hope, I believe God will intervene someday.

a lot of tins just the make us loose focus on seeing say the beta change we dey cry and pray for e dey our hand and na only wen we Nigerians don really ready to take that change into our hands by all means necessary na then we fit start to see life for inside the Naija but till then na just so so from one level of sufa to anoda we go dey face till we decide to ready for de new beta change we de find from we gofment.
We know say e de our hand to make the country better and so far we have tried our best in the best way i think we can because we don de try vote people in with our hands, people wey we de feel say go make change but no better result so far na so so promise and fail we just de see up and down but i never still understand wetin you mean by all means necessary because i never understand that part hope no be wetin i de reason you mean because i think that will be too harsh and in my opinion it’s not proper. We will do our best and elect who we feel can do better and leave everything for God to handle.

na true naija youth really get power and when dem try to do something dem de give am their all and result de surely comot but Wetin you de reason because i don try reason wetin we fit do to make this change but nothing de come head maybe you fit share you idea with me make i understand properly.