Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: We Nigerians never ready yet for a beta new Naija.
by
CryptopreneurBrainboss
on 05/10/2023, 09:38:23 UTC
I know my country people, the typical Nigerian wen him put him mind in to do somtin he dey do am to the fullest to make sure him get wetin him dey hunger for. make we use cryptocurrency lik bitcoin for example. see as Nigerians enter the crypto market one hand inno even tey sef naw na we dey front for Africa and even for the world if them dey tok about 10 countries wey citizens dey actively involved for crypto Naija go follo for that too 10, na bcos we put our mind wit hunger to do well.

Na because our country no good like our country no follow, others wey you dey see say dem no too follow for this list na because their governments dun make the economy of their country better wey be say if their youths hustle small dem go fit dey live a better life. Immediately we humans get comfortable we begin to lose our hustling spirit and na so all those white dem dey na him make e dey be like dem no get interest in cryptocurrency because their system dey work and that's why we dey always japa go their side. You think say if the country dey work very well wey be say as you finish school, you go get better work wey dey pay you well say you for they reason this industry? We dey here because the country no follow and work no dey and our population too much and na him dey push us upward for the crypto world.

Quote
Na with same energy too if we all don really ready for a new beta Nigeria inno go take 2secs we go get the results coming. Na the powa of Naija be that but plenty of us neva start to mk use of that powa wen it com for gofment and politics na why we country Neva be as we want.
you sef reason am!

For this side I no go talk say we never ready because we dun really ready but the kind politics wey we dey practice here no get fairness. Oya see last election wey we come out vote yet dem still steal our mandate carry give person wey we no vote for. This na how Nigeria politics dun dey and e go hard to change that way because protest self no dey too work for the country as where men gather plan, others go go behind go take handout and forget everything wey we plan to do. The youth dey hungry and the government know this one so if dem fit capture the main people wey dey organized the protest dem dun end the whole thing. See as dem shot people for lekki toll gate yet nothing the happen up to today and Nigeria strong wey be say other countries dey like comot hand for our matters.