Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Government Really Value Our NYSC?
by
CryptopreneurBrainboss
on 05/10/2023, 12:44:00 UTC
I mean all these our NYSC bordas and sistas wey don devote their time and lives to serve this our contri.
E don dy almost go plenty plenty days and weeks now wey them kidnap some NYSC members for Calabar and our government no dey put force to bring them out, and with this act I no sure say people go fit summon courage to go serve.

If you no go serve na yourself wey you dey do and not the government because NYSC is a mandatory requirements for every graduate unless you graduate very late wey be say you dun pass the age to serve na when dem go give you exception. e dey pain me say people wey comot house to go serve their mother land enta this kind wahala but na the country wey we dey and the insecurity wey dey the country na wetin dey cause all this ones. The government and the citizens care greatly about anybody wey dey serve our mother land through NYSC because if you see the kind privileges this people dey get ehh. I dun see many occasions wey be say police dey free motor just because person where NYSC uniform and other instances like market women dashing dem things and other scenarios dem. If same thing for happen to orders na so e for be too (no quick response from the government) because police officials and other government officials has been kidnapped before and nothing was done quick for their release.

Quote
E dy pain me say we still dey go for all these things when government call on them, abi the NYSC no get right to say no all these government related things? I still dy ask, e really dy comporsary to go serve still come out to continue dy suffer as if them do wrong for the nation?

Yes very compulsory because without am you no fit secure better private paying job and no government job entirely. My advice go be make we dey try work our service because na wetin most people dey do. No go dey do good citizen go serve for where you go get problem because if you lose your life, the world no go stop for you. Highest na 1 min silent and fundraiser and e dun finish. We need to dey protect ourselves because na wetin dis country dun turn into. If you get the finances, work where you go serve or redeploy when them post you go where you life no dey secure. No go say because dem kidnapped NYSC people you no go serve or all your school years will be wasted and no go talk say you no need the certificate of completing your NYSC because e go worry you for future. We no know how tomorrow go be and we need dey prepared in every aspect like having all qualifications you have achieved like graduating from the University to avoid disqualifications.