That Chibok girls matter if you know wetin and wetin dy inside that issue you go know say e get wetin them no want the public to know, them let us hear wetin them want us to hear about Chibok girls own and this one no be same thing compare to the children from Chibok. For me oh that abduction nah political movement against Good luck Jonathan.
We no go fit categorically tok say doz chibok girls issue nah political set up by the rival group APC to take scatter ourJonah Govt as we no get proof to take back am up but make we come gree say nah planned work, ngwa dem don enter seat why dem no release the girls to their parents.. this mata serious as we all know some of those girls don turn mother's for their hand and nah this same chibok mata we hear of Leah Sharibu. Make I no divert Sha but wetin I wan let you understand say for these things to stop to repeat, we govt must tighten the area of security else any govt wey enter go face that same challenge.
Kidnap nah kidnap oh but e get wetin dy results to all these kidnapping, as for the
NYSC own, two things fit be the cause as nah community something...
E fit be say nah boys wey just reason to make that kidnapping happen wey no concern top bodies (political matter) like the Jonathan own and e fit happen out of envy, because e get as these our coopers fit package reach people wey dy around fit decide to kidnap them make their papa and mama them pay something thinking say them hold paper well well... Nah wetin I think oh but still on still government need to do something to solve this issue.