Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 2 from 2 users
Re: Ghana preparing to supply Nigeria electricity.
by
HajiBagi
on 06/10/2023, 15:35:06 UTC
⭐ Merited by hugeblack (1) ,RockBell (1)
When I saw this update I just had a bitter sweet feeling about it, the sweet feeling is that our Ghanian brother are doing well, the bad feeling is naija my country our government don't even care to rectify our own problem, the refinery issue, as big as this country is there is no refinery, even though dy wanted to remove subsidy as already being done, provision should have been made before the removal of it, now look at how inflation has taken over every thing in the country, and the government are not even learning from there neighbours.

We just dey Para every day about our country, but waiting I wan make we understand now be say no matter how we dey talk the problem wey we dey face for Nigeria he no go finish, waiting we supposed do be say make we chill as, reason waiting go make our country good for us, as I hear this update now he dey sweet me because na help Ghana wan help us and he go good wey our country supposed get light, although I know say na Nigeria dey supply  Ghana with some things before but due to the progressive wey Ghana dey find dey cooperate and make their country better country, our leaders Don fuck from the beginning and as the matter dey like this he go take time wey Nigeria go come back to his normal ways.

No be say we no love our country oo, in fact I love Nigeria, but our habit no good and na waiting dey kill us be that one, we Niger get one thing, if we Don get we no wan dey give people wey never get and we know say God no be like us, he fit change everything about person wey no dey give and give to person wey deserve it, we get many resources wey dey bring money to the country but our leaders no dey let us feel like say we get them, all this thing's wey we dey face for Nigeria na greediness, I swear greediness no dey Allow person improve and even country wey greedy too much it will never improve.